SONG OF NAIJA MAN NAIJA NO GO DIE
- I dey wonder for all dis wahala
Wey dey de kneck of Naija!
- Problems de for back
E dey for front, where e dey dark
- De ground dey shake
De sky sef dey shed tears like say big wahala wan break
- De air as e dey, dey too hot
And de water dey red for every spot
- I come remember say
We dey for a very bad day
- Boko Haram dem dey ravage North East
ISWAP and Lakurawa dey sack North West
- North Central dey cry
South West nko? e dey for standby
- Other zones dey worry
Common man no know where e be
- Kidnappers dey kidnap every day
Armed robbers too, everywhere dem dey
- Ritualists de too! Na wa!
As 419 dem dey every area
- We countri need plenti prayers, plenti actions with fire power
Make everybody join hands together
- Make we pray seriously to Baba God
Make im open for us better road
- To take us to the land of peace and harmony
Where friendship and love dey plenty plenty
- Naija no go die
All im devils we go bid goodbye
Ade A. Ajakaive


Leave a Comment