SONGS OF A NAIJA MAN PALLI......WETIN?
- Govarment come remove fuel subsidy
And everybody dey lose gravity
- Dem come bring palliative
Me, I dey smell purgative
- As subsidy don go
Poverty dem don begin to grow
- Fuel station don chop all our money
We no get nothing to fill our tummy
- Our daily routine be garri, eba and garri
Hunger don finish all our "faari"¹
- We all don become mumu
Looking for wetin we go chop and mu²
- We dey beg our govarnment make dem put us for top
Unless, if dem say dem want us to quech and rot
- I beg our very able presido
As we dey now, we no fit last till tomorrow!
By Ade A. Ajakaiye
Ibadan


Leave a Comment