SONGS OF A NAIJA MAN PALLI......WETIN?

 

 

  1. Govarment come remove fuel subsidy

And everybody dey lose gravity

 

  1. Dem come bring palliative

Me, I dey smell purgative

 

  1. As subsidy don go

Poverty dem don begin to grow

 

  1. Fuel station don chop all our money

We no get nothing to fill our tummy

 

  1. Our daily routine be garri, eba and garri

Hunger don finish all our "faari"¹

 

  1. We all don become mumu

Looking for wetin we go chop and mu²

 

  1. We dey beg our govarnment make dem put us for top

Unless, if dem say dem want us to quech and rot

 

  1. I beg our very able presido

As we dey now, we no fit last till tomorrow!

 

By Ade A. Ajakaiye

 

Ibadan